Na for Yankee my brother's wife kpai. The gist plenty no bi small and the mata dey bring water for eye.
Na nurse she bi for hospital,she dey overwork no bi small. She dey try to make life beta for him pikin and husband until gbam! She drop like chicken one morning.
Dem kon confam say she don go meet papa for heaven.
Hin husband and pikin suppose go meet am for yankee but village people show face.
I,Omokomolafe aka Omofe as my boys dey call me no fit cry but e touch my heart as I see my strong broda dey cry like pikin.
E pain am,e pain me, e pain everyone but na only Baba God sabi everything wey dey occur.
I chukulu like sand , I no fit Sabi wetin God don plan.
"Omo,the sun hot no bi small"
I don shout this thing like five times and the five pure water wet I don buy dey chop my money. All thanks to Tinnubu baba wa.
I slap the yellow danfo bus "Akute!"
Omo I don dey H. Make this bus on time make I go chop for iya shukura place.
"Fine girl, dey smile small small na,your face dey shine o"
I know say na only cruise I fit catch sha because the only reasonable thing wey I don get for this life na secondary school certificate for gbegira community grammar school. I no say I no fit, I wan hustle first make am make Baba God help me.
At last, the bus full and I signal to my oga make hin move.
"Anybodi wey take this medicine,fear no go catch am,you go dey pray for us sef"
Dem don start,chaii. Somebodi no fit live an ad free life for this Lagos.
The man continue,
"Madam ,this crawcraw wey dey your body, e go clear am"
He kon push the product wey labelling dey peel to the aty I talk to.
Sharp babe.She reply am "uncle commot your product from my face, sure say e get nafdac number"
Everyone for bus laugh.
"na my goosebumps you dey call crawcraw, you no even know wetin your product dey for"
We don pass berger, we dey pass the bridge wey dem never complete for five years to the bad road wey politician don use make promise for their manifesto for the same five years.
Nawa o!
"Dear all,Good afternoon,I hope everyone is good. Now I sabi say the economy no good. Baba God know the kain suffering wey everybodi dey face"
Omo I never see pastor wey him shirt get getor and him shoe dey shine preach for dis kain wowo danfo bus.
"He tell me say make I tell you say e don send hin only son wey He love-Jesus Christ. He talk am for John 3:16. If we accept am, we fit get through the things wey tough and we go dey alright".
After the trip, I branch iya shukura place and after I don belch like two times I relax from the hustle.
Tomorrow we go again.